“Osun Osogbo shrine porn video”: Tobi Jolaosho ‘King Tblak’ wey act ‘blue film’ for Osun forest don land police net

King Tblak

Tobi Jolaosho AKA ‘King Tblak’ wey chop arrest for ‘blue film’ (knacking kerewa) e act for Osun Osogbo shrine dey tell Osun State Police Command wetin make e go dance kerewa for holy forest.

Di Police Public Relations Officer (PPRDO), Yeisi Opalola confam di tori say dem arrest di man afta one member of di Traditional Religion Worshippers Association come tell police.

Tori be say oga Jolaosho bin dress like Osun worshipper wit one naked woman for di grove for July dis year come shoot di feem share am inside social media.

King Tblak

Amoo Awosunwon of Idinleke Temple say im see Jolaosho dey act di sex feem for di grove and say im actions fit cause public kasala.

Jolaosho wey dem dey also call King Tblak HOC dey call imself say im be porn star and get pass 20,000 followers for Twitter wey im dey post video and 109 mllion views for im website.

Meanwhile di PPRO for Osun state don tok say police don visit di area wia di crime bin happun and afta investigation, if dem find out say Jolaosho go against di law, dem go cari am go court.

Di Araba of Osogbo, Yemi Elebuibon wey be traditionalist say Jolaosho desecrete di grove wey be sacred place and na di traditional worshippers for di grove go plan how dem go take deal with am.

Osun-Osogbo-shrine

Di Osun- Osogbo Sacred Grove na di place wia Yoruba pipo believe say di god of Fertility dey stay and according to UNESCO na one of di last remaining primary high forest for Southern Nigeria.

In fact for 2005, di United Nations Educational, Scientific and Cultural Organisation, Unesco, name dat place World Heritage Site

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *